THE FRAUD OF POWER WITHOUT PURPOSE

The keyword is willing today
But the brain is doing akanji (kick to start)
Like average Nigerian lazy yoots
In fact, it is doing tikotiko
Laik diesel engine wey water enter im kabureto
The way the keyboard is looking at me sef
E be laik say I go vex for am.
Nor look me laidat o.
Na truth I dey yarn so
One long time Imo river
As I dey lecture for ogbonge school
The old Mayo Associates
Wia dem dey produce ICAN students
Na im one aftanu, one student say e wan gist me
Baba God sef know say I laik gist
Beht as I nor do freedom, I nor graduate reach amebo level
E come say oga, come hia wetin I hia somewia o.
Na one kuekue accountant laik dat
Dos we hol RSA or Pitman certificate abi?
Yes, you get am oga
Im come say people dey hala am on top wetin dey vex am
Dat im nor dey fit balance account at all
As in reconciliation of account.
Say na only account nor balance, beht money nor miss at all
I come ask, how we go take know say money nor miss nau
My guy talk say the tin taya am sef
Anoda tori wey I remember
I dey use am wella for forensic accounting class
Wen I dey do facilitator laik dat before
Weda na kwaret tori or fabu I nor come remember sha.
Na for Port Harcourt and some auditors wey go look books
As dem ready to vamoose go Lagos
Dem come call cleaner make e sharply arrange wetin dem don scatter
Na im the man kuku dey ask if dem don ready to go
Dem ansa say yes o, we don finish work wella
E come ask if dem nor see anytin
Dem ask am wetin e dey yarn
E say im nor sabi auditor work o
Beht somwan took aeroplane from Lasgidi come PH
And come dey distribute Onitsha bread for im paddy
Na im auditor sharply use im namba six
And comot their load again
Come check all waka waka expenses reach ground
Dem even call the aeroplane company join
To now come see say dat all the tickets na arrangee
Shai come see holla as oga we dey do the waka
Nearly wee wee for bodi
Money don enta shalanga finish
So na so fraud full eveiwia for our obodo
Okay, Mr. Village boy, what is the moral of the lesson
See me see wahala o
Which taim I start lesson nau
Abegi lif me alone
Henhen as I dey yarn before
Wen you kolet power and no purpose to use am for
Is it not laik persin wey nor fir balance account
Beht dey yarn say money nor miss
Or laik persin wey tuk aeroplane from Lasgidi
And come take one leg branch for Onitsha
To buy Agege bread for im paddy for Port
How e take bad sef
As gbomogbomo dey everiwia wey power dey nau
Na which power dem come get
Wey dem nor fit stop all dis bad bad tin
Wey dey hapin for our obodo
Dat wan nor be power without purpose
Wetin I even know sef
I can not come an go an kill masef jare
Make I go back to sleep
As my brain nor wan work today
You fit tink about am sha
Wetin be the koko of the power
Wey dem luk for
Wetin dem don achieve
Okay, bye for now
Before dem begin yarn, say
Village boy don talk bad somtin
Helep me ask dem
Wetin dem dey use dia pawa for o.
©TheVillageBoy.

Recent Comments

Leave a Comment